You see say I no too dey follow woman laugh; E get reason. Cos you like a babe doesn't mean she likes you ooo. Wen guys like a lady; dey become playful with dem and make a whole lot of jokes. Na wetin me sef do ooooo wey I chop confirm beating. I dey JSS 3 dat time. Just dey learn all those
swags. Some people don dey whine me fine boy. I like one babe like that. Person wey be giant. I no toast the babe but small small I dey let her know say we be paddy. I go to her sit quite often to joke; I no know say the babe na Brock Lesnar.
On this fateful day, our maths teacher give us some hard questions to solve. Everybody dey rack brain. The thing hard no be small so since the woman comot class temporarily, everybody begin collabo. Na so I see my crush dey copy from another guy. E pain me cos she no even show my side come look my own (why would she. Me wey everybody know say I be olodo). Instead make I respect myself, I leave my work go find trouble. I no know say the babe blood dey hot from the maths.
As I reach there, my intention na to put my hand between her face and the book, do small play and maybe join in copying the work but as I carry my hand; na the babe eye my fingers enter oooo. In that quiet class wey everybody serious come be taise!!! Na slap be that ooo. The whole class look back, even me sef I shock. Before I recover na another one and I no turn my cheek like Jesus advice. As I sharp guy, I try savage the situation come dey stagger playfully comot the scene like say na play but Obongu no gree ooo. The babe climb table still come where I dey pound my face. I was helpless. If I raise hand e go pass that one. Shame catch me. Thank God say na Friday if not I wouldn't have come to school the next day. I come believe say karma na true cos I don laugh one of my guy too wey babe slap for JS 2 (this one own dem fight but d babe slap em head go wall and the head swell up). The guy laugh me too. Till I comot that school for SS3, I no follow that girl laugh. On the 9th anniversary after the slap, she send me Hi for Facebook. I no even reply.

Lol dat kind hot slap wey go dey do u like Bollywood film
ReplyDeleteVery interesting I swear, I really felt ur pain.
ReplyDelete