Sunday, January 29, 2017

tear tear boxers


Despite the recession I don dey fat. Na Baba God do am oooo. All my agbada be like slim fit come get fitting. I dress well, hot boy like me but like most people na only wetin people dey see dey clean. I no mind my tear tear boxer as I wear am or the white-turn-brown singlet I wan wear, afterall, who go see am? If na club where I fit do quickie I go use clean one.

As I enter church, everybody just dey look me and dem must sneeze if I pass dem side because of the heavy perfume wey I wear. Infact, I use half of the bottle. Wetin concern me. Church no even need air freshner again.
Na so I enter Sunday school class. The setting na just chairs arranged round so everyone can almost see everyone perfectly. Me wey dey feel fly, I spread leg like boss dey feel myself.
I come notice say all the babes for class just dey look me.  Forget am, if u hot u can even get the sisters in the lord I thought. I come dey use my eyes too disturb dem. Small time even guys dey look me. Ahan, so even the brothers in the lord dey do gay? Na so one cool breeze blow, d breeze chill everywhere. I surprise wen my brokos (penis) sef feel the breeze. The clothes heavy na. As I say make I bend down look like this, I see say all my prick dey outside. My sokoto (trouser) don tear, d tear tear boxers sef no help.

Na with shame I get up go house. I don dey miss Sunday school since then.

No comments:

Post a Comment