Sunday, January 29, 2017

My abandoned bible


If God wan disgrace you, He will in a beautiful way. I never read bible for weeks now, I no know say one cockroach don get hospital wey em dey born children inside my bible.

Na so one Sunday I enter Sunday school class which as usual is arranged round so everyone can see everyone and make it more interactive. As I open the zip of the bible, na so one ugly cockroach run comot. My heart cut. I look left, look right to see if anybody see the cockroach but nobody see am but the mumu cockroach no behave himself. The cockroach come dey waka up and down for the class, I wan die. Shey I wan dey pursue am?
As one mumu babe see cockroach, she shout like person wey dem shook stick for em’ yansh. The whole church shock. I almost enter ground. Everybody come dey pursue cockroach before dem kill am.

Our Sunday school teacher come dey joke say the cockroach fit comot from person bible. People come dey laugh. I don’t know what was funny. Be like say make I slap the man.

No comments:

Post a Comment