No be every asset be correct one ooo. Babes go dey think say coz dem gather dem fit dey pose like Baba Fryo. Assets aside, you need a fine face and if God no give you that one; you need a good character.
One hot afternoon after much stress I enter keke maruwa to my house so I no even look the babe wey
dey my side and the road dey bumpy so the keke fidget making me dey swing like pendulum to and fro- thin air to cushion for my back- with a smile I realize say my back dey tap current😃and I cum dey exaggerate the movements.

To my surprise the babe wan use her front push me comot the keke and one spirit just say make I look d face. I swear it was like OMG😓. If na fine babe I for lean back like Fat Joe but with a face like dat; I bend towards my knees like person wey chop poison. Every contact became irritating and I still dey feel that rub till now, 8hrs later and after plenty bath.
I no say no be she create herself but I just realize say assets no be everything.

Lmao asset pass asset
ReplyDeletesome faces can make any asset absent.......lol
Delete