Thursday, January 26, 2017

Oya come down. Shey u wan cut light?


Everyday for the Nepa; one day for the people. Dem go give us light worth 200naira and go still bring bill 4500naira. We dey pay, we no dey complain. Na so dem dey cheat us but we no get choice cos one litre of fuel na 145naira. But all you nepa people, if you wan cut light abeg reason the timing. Bad timing fit give you story that touch. Ensure say dem no dey house or light no dey cos you no
know wetin dem dey use am do. Make I nack you one story wey happen for area in 2008 when Nigeria dey play Belgium for Olympics.
This Belgium strong, dem get plenty stars but Naija don dey win 1-0.Na so light off. Na so Nepa dey do and Boys don go find 100naira with the mind say make dem go look the match for viewing centre. But as dem come outside, na so dem see one idiot on top pole dey cut light anyhow. Guy wey boys don mean. Em go dey do like God wen time to cut light reach. ‘You don die today’ boys begin vex. The guy no gree come down after we call am like Jesus call the twelve disciples. Na so another guy climb ladder go meet am push am down. The guy leg break and boys ready to kill am. Em come dey beg say na em oga send am message.
Boys enter nepa office go meet oga. In what was a tragedy, dem kill oga. Na true story.
Moral lesson: Never push submissive people to the point they revolt.
                           Even when exercising your rights; exhibit wisdom and consideration.

                           Violence is never an option. Never take the life of another.

No comments:

Post a Comment