Some days after you look mirror see yourself; you go get
self crush. Na me be this? Good make person get money. I don dey save for this
day. All the salary for the part time jobs I do, I save am use am buy clothes
to do show off. All those people wey downgrade me gats to feel me. I no know
say I go still chop disgrace.
I went to a private school where dem no allow us dress to
our potential. Dem say na only corporate wear and if you are ugly before; your
yansh don open cos nothing to hide it. I was a victim. Hunger wipe me for
school so tey I thin pass my bone. So after grad, there was still one more day,
when u wan collect nysc call up letter (na all the grad set go show), to come
show people say you get the swags oooo and na just school dey hold you back.
Na so I begin gym in anticipation for dat day. After 3
months of planning, I know say all those babes wey no gree for me go regret wen
dey see my swags. I enter market buy timberman shoe (not timberland). I buy
jean trouser, buy sweater long sleeve (and the weather na krawlkrawl weather,
so hot), buy dog chain, buy dark shade, cum enter saloon cut hair like
Ludacris. Me sef I melt for myself. I was at my hottest.
Wen we reach school, I felt the life of a celeb. Come see
how people dey famz me. As usual, haters dey, dem say I wear my Christmas dress.
Me I no send as I get all the attraction. I see some people phones dey snap and
I begin bance dey pose for the mamarazis. As I dey bance I forget the basic
instruction for crossing road. I dey bance dey lick lips no know say one keke
dey come. Na God say make the keke no speed, na dere I for die. But people fall
for ground dey laugh wen the keke jam me. And u kw how all these Yoruba people
dey yab, he insult me say shey na
because of the rainboot wey I wear dey mk me waka like drunkard……….na the only
thing wey I remember be dat cos the laughters just dey echo for my head.
I just go sit down one corner afterwards, hide my face.
Luckily, I dey one of the few posted to Lagos were I no still respect myself
for camp

No comments:
Post a Comment