Everybody dey complain sey big brother Nigeria dey hold for
South Africa and dem say it’s ridiculous like say the organizers no get sense. On first
look, it feels that way but on a closer look, don’t you think dey know what
they are doing? Imagine make Nepa comot light at the point wey something
interesting wan happen.
Ehn dem no fit buy standby generator? If the noise start na
una go dey complain of sound problem. The show is an indoor reality tv show and
doesn’t show or represent imagery of Nigeria in particular. The only difference with this big brother na
say na naija people dey dere.
Multichoice, the organizers talk say a fully equipped house
dey South Africa wey don host Big Brother Africa and Big brother Mozambique,
Angola and now Nigeria so we no be the only ones wey no get sense…..lol😁. We no
get fully equipped house for 12 people dem talk……lol. Another thing na say
maybe more advanced equipment can reach a wider range of audience across Africa
and bring more revenue. Anything dem wan do, make dem do. I shaa wan see wen
dem dey baff for morning shaa😈.
The one wey pain me na Federal government wey wan probe the
shots for South Africa. Wetin concern dem? Na una sponsor am? Dem no go probe
better things like all the bridges Amosun abandon for Ogun State.
My pellow Nijirians shaa enjoy the show. We no get
accommodation for 12 people. You can help the nation by donating your house if
it’s well equipped.

No comments:
Post a Comment