Ok comedy is everywhere if only you open your eyes to it.
This particular one happened in 2013, then I was in the intensive care unit
(ICU)…….yes oooo dem winches wan kill Desire too. Na the guy wey dey next to me
dey make me laugh. He said armed robbers shoot am for prick. The guy, em mama
nd em pregnant teenage wife were just natural comedians.
I dey battle survival when dem bring John (not real name),
who apparently went to buy fuel at a filling station and was unfortunate to be
present at the time a robbery was taking place and he was subsequently hit by a
stray bullet in no other place but em’ prick (gossip had it that he was likely
a robber)
This guy black pass my yansh and em mama no get any money,
she dey even find cash for em bills. Initially, I no send dem but as dem start
their drama; I forget say I sick. That em wife, about 19 then, go raise the guy
wrapper (which he wore on his waist) dey check how em’ brokos dey heal.
Everytime, she does that, you can see the excitement in her eyes and the big
smile she puts up. I come dey wonder if that guy go fit still perform.
The mama sometimes go buy gala come, she go give John one
while she and her daughter-in-law share the second gala, wahali, laff dey
always catch me. One day I whine am say she lucky say she get better daughter-in-law.
No be rubbish pikin
dey get belle anyhow? I send am go learn work and em dey go f**k
‘But children na blessing from God’ I reply
‘well na true but this
John na animal’
True true na animal oooo. Na so the weyreh pick phone begin
call 3 girls.
The first one; Hello Aisha…na me John, dem shoot me for
brokos
The second one; Hello Philo…..na me shadow, dem shoot me for
prick
The third one; Hello kudi……na me blacky, dem shoot me for
penis.
What manner of guy was this….3 girls, 3 nicknames, 3 different
names for his cucumber. I just dey look the cheat.
Na so em wife enter later say the guy get text. Em come dey
vex say she don read one of him messages. The guy come talk say when he well
say him go beat the girl and na so the foolish girl too talk say ‘you think say
I don forgive you the last time wey you beat me’ I died while laughing and woke
up to see the girl checking his prick again.
I left them and thankfully Desire is well and hearty.
Hopefully John is too and has made his wife a mother Abraham with the kind konji
addiction I saw in them.

No comments:
Post a Comment