I sit down my own side jejeli like christian wey just repent and no need temptation. I dey mind my own business but one thing with figure 8 just pass me dey gimme green light. I come fall like devil when God throw am comot from heaven, but these girls are very wicked. Dem just want to play with somebodi emotion.
Though I manage collect her number; the babe very rarely picked my calls. Make we see: No! Anything I propose: No. Na so I violate the first of the ten commandments when I had another god😀. In five months, na twice this babe flash my number and I go dey look my call register like 'She actually did'. Such was the depth of the crush.
Gradually I come realize say no road for this desert come dey try overcome the feeling. Luckily, I relocate go north from west; distance sef make me happy but one night! One night! As I dey sleep; I dream say I dey koko this babe, it was so real that when I woke up; I don pour.
As I dey lament; this babe wey never flash me in months, flash me at 3am! Na that moment I confirm am Karashika. No go area. I no call again. I hear say she don marry now. My medical student friend told me there is a scientific explanation.

No comments:
Post a Comment