Smelling tomato. Who want to eat this one? Have you ever gossiped with your friend via chat about someone irritating sitting next to you without knowing the person is reading all you are typing? I was
almost a victim oooo.
That day I say make I comot school go do weekend for house, refill my pocket and chop meat since na vegetarian university I dey go. After I enter Lagos, I enter another bus wey go carry me go my area but the fat, black-shinning, smelling woman wey sit down next to me be like champion. She carry one basket of smelling tomatoes. Only God know wetin she wan use am do or where she see am. E fit be awuf. She press me go d extreme end of the bus; I almost suffocate. Her sweaty hands just dey rub my clothes, stain am. The woman sweat dey evaporate so tay it come dey rain for inside the bus. It was that bad.
To console myself, I pick up my blackberry phone come dey chat with my guy about the woman wey sit down next to me, I no know say e dangerous. As I send am finish say make I even look the woman again; our eyes just jam. My heart cut. Water almost comot. I wanted to tell the woman say na slip of finger since I no use tongue type but she just tell me say make I open the window. Whew! If she know wetin I type; one tomato in my mouth and it's lobatan.

No comments:
Post a Comment