First, second and third.....KENYA. See self.....add 5th and 6th. Dem win am. Even for women category. Na so that Abraham Kiptum just come our country come collect $50000. And na em win the last one ooooo. That is $100000. Abeg convert am to Naira. We know that when it comes to this, Kenya and Ethiopia no get rival. Please make it a Nigeria something. After all the glucose and juju I do I still faint for road.
All my guys wey follow us run still dey bed oooo. Body dey pain us like mad. Those Kenya guys no dey tire.
Abeg who get that 7yr old pikin wey run. No be child abuse or na talent exposition? The guy run pass me like winch. With shame I pursue am, na where I faint. Disgrace😃
Drama no fit end, the first check point I reach say make I shak some drink, na so we hear say area boys don weyleh every body carry 500 cartons comot. The olopa we yan tell us say em never ready die and how much be em disability bonus?
I dey find massage like badly now but no bae to massage cos I break up January 23......I no get money for val........lol.

No comments:
Post a Comment