When I visit my guy for Enugu, he carry me go one pepper soup joint. Dat night as we dey party dey dance, dey chop isewu everybody just dey shout 'where Bosco?' 'where Bosco?' I come dey ask who be Bosco but them talk say na Big boy. Say if the guy show, e go foot everybody bills. Na so I begin dey pray make the guy come. Who no like better thing?
I don tell the bar man make he keep one crate of beer incase Bosco show. As me and my guy dey manage the one bottle wey we buy: na so people just dey cheer. Bosco don come, Bosco don come filled the air.
When I finally see the Bosco, laugh catch me. The guy muscular like Arnold Swagnigger😄 na so dem dey pronounce am, the guy physique no come make sense when you look the tennis ball head wey stand for em neck. The guy head small no be small.
I just dey surprised. Maybe na because of the drink; I shaa go ask am why em head small.
To everybody surprise, Bosco no vex. Maybe he don high.
Bosco come tell us say he do juju hammer and the priestess wey do am for am dey every impressed so she asked for three wishes she go grant am after the money.
The first wish na for stamina for hot sexual rounds. The priestess grant am but since he no fit see am, he decided to test it on the ugly priestess. So he turned the priestess to a beautiful girl for correct wiping. That was the second wish. After 3days of non stop, na the priestess even tire. She asked for the third wish.
Bosco wey dey konjified😄and never pour told the priestess 'abeg gimme small head'

No comments:
Post a Comment